The new single serves as a follow up to his previously heard single titled, “PTSD ft. Odumodublvck”.
The song “Lost Girl” is a wonderful number which is a must for your playlist.
My name na Erigga For those wey just enter my school of thought The things we thought before motivation We’ve been on top But I’m still lost
Lost in my thought Finding fault Is it mine? Is it yours? Funny thought Before the story drop why don’t we take some shots
Warri crisis 1997 enter 1999 really shape my thinking Lost a lot of my bros and sists in a blinking Forget the oil for ground, I refine the one for my head Made money but I’m still lost
Part of my still lost Toast to the thinking “entitlement go make us rich” People switch like fake yansh and real yansh It’s hard to tell which is which
Lost in the women and the drinking smoking and hoping That one day my government go serve me Dem no tell me before I switch to investing in myself Empty my savings 1999 for okumagba avenue 9 Erieovo Deepest part of the getto, darkest, everyone know
Africa wake e dey happen People dey hear the voice now e dey happen Brezz go blow small small politicians yansh go open show Fowl dey beat ole fowl, e dey happen Sleeping sons of Jacob wake up, e dey happen Everyday for the thief but one dey for who catch am, e dey happen
Erigga too good God make dem dash am With all the things he’s been through Nothing scratch am When God say na your time na your time
No matter the continent you find yourself or anywhere you dey Na still your time ’cause na thesame time But at the same time we dey grind
I know people when tell me say my album go flop Fast forward them shock to see am they pop I rather dey on top chart than on top your girl Money na the only friend we fit rely on well
Na me be that basket way dem de use fetch water Just to disgrace bucket, stop playing with me
If you dey go through alot my brother go come, stop playing with me We have all been through there no use sub me, disturb me Na beggie biggie make you feel say ur brother stingy
Entitlement na disease enter pharmacy For am to pain I gats talk am for pidgin Nobody owe you chi chi so brother namaste
2016 I dey cell dey think my life Dey write for wall I swear I almost mentos For matter way no concern me, naso them find me Hand cuff me like arm robber when dey pem tools That was then I no sure say e fit happen again
I’m wiser now money dey I can’t complain Never to catch falling knife leave them make dem talk Na ribina una be, we no be God We no be blood A king and a slave for it is both our duties to serve others Ballads of a lost boy
The movement just dey start Una go soon dey take orders Abeg